Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
GiftedMAN
on 23/11/2022, 13:49:30 UTC
President Buhari unveil New Naira notes
Our number one for the country Don approved and unveil the new naira notes today during the weekly executive meeting at state house. CBN governor say the new naira go begin dey circulate as soon as possible while the deposit of old ones will continue. You can read full details here Buhari unveiled new naira notes
Na the image be this
Na only colour dem change thou. I pray make e serve the purpose dem do am for cux our problem for naija pass extra ordinary.

Abeg wetin una think say be the difference between the old naira note and the new one? The new note be like wetin dem use snap chat filter take print e no make the money get any thing new and I no sure say the money go get any value because before our politicians dem do anything dem dom already get wetin dem wam gain so I no see any good thing for the money wey dem redesign unless the money go circulate reach everybody hand as them been claim.


I dey disappointed say our president Buhari get mind carry governor of Central bank Godwin Emefiele, minister of state finance and budget and national planning Clement Agba, even Efcc boss Abdurasheed bawa and others come unveil new note wey dem say cost billions of dollars to print but nothing dey new chai nothing we no go see for this PDAPC regime na only our voters card go save us.