
If really dem do dis won 👆, nai I go like well well. Di small small Moni dem wey we get for di kwantri e no fit use am buy anything again. So if dem implement dis won nd print more on dis won. I go Happy.
If dis happen for naija, e go give me joy pass d one wey dey redesign the naira notes. E don tey wey dem suppose introduce back this kobo seriously. Our value for naira don dey drop drastically and dis initiation of kobo can help counter it in some way. And Im sure price of goods go reduce in a short time after the introduction of dis new notes and also dis news of bringing back kobo go help too if it is duly implemented as stated there. Me I no lose hope for dis my country, hopefully one day e go better for all of us here. We don try together with the country to survive reach dis stage in life.