Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Marykeller
on 23/11/2022, 19:39:38 UTC
President Buhari unveil New Naira notes
Our number one for the country Don approved and unveil the new naira notes today during the weekly executive meeting at state house. CBN governor say the new naira go begin dey circulate as soon as possible while the deposit of old ones will continue. You can read full details here Buhari unveiled new naira notes
Na the image be this
Na only colour dem change thou. I pray make e serve the purpose dem do am for cux our problem for naija pass extra ordinary.
The FG or CBN governor suppose tell the general public sae all the naira note from 2021 backwards dem no go accept am as legal tender again. Starting from soso time to this particular time. People no go d collect naira note wey get date of  2017,2018,2019,2020 and below.

This government no d surprise me again. I never see anything wey dey go fit do right apart from stealing our money.

See wetin d just do. Just to color our money and come use the word redesigning come deceive us.