
If really dem do dis won 👆, nai I go like well well. Di small small Moni dem wey we get for di kwantri e no fit use am buy anything again. So if dem implement dis won nd print more on dis won. I go Happy.
omo this one na spicy news oo because this our so called Naira note Don loose value well for this country. 5naira sef no be money again because even the least banana chewing gum you no fit use am buy.
So at least with this update maybe e go force people to respect the naira small because most things we go dey buy am for kobo, 1 Naira etc.
So if Nigeria go fit implement am e go good well well
This naira new note just dey trend and Nigerians just dey disappointed. But me I no see any problem with the new note. When we hear new naira note, what we're we expecting? Something like dollars or pounds? Naira note dey durable and beautiful already, so the purpose of new notes no be to make am fine and put flowers. The purpose na to make people wey hoard naira release am and render sum useless. We don already see the effects as old old money dem don dey fall out. So, wetin dem need na just to differentiate between old and new, the color change is OK for that.
This one no go work, I know when dem been try implement this but e no work.
DaNNy001 and uchegod-21 your quotations are wrong, so you can re-edit it before another person also quote it wrongly. The redesigning of the Naira is not a problem in Nigeria, but the problem in Nigeria is the price of goods and services. If any government can reduce the prices of goods and services and also create Enabling environment for the Citizens and the foreign investors then everything will be ok in the country. That is why some people are saying that they should approve the use of coins either on paper or on the normal coin.
To save Nigerian economy is to accept the payment of 1 Kobo to #1, and to #50 massively than #100 to #1000