Omo, like dis everybody dey para for the redesigned naira notes. But wetin I Kno be say wetin don happen don happen. We dey lament say we govt corrupt and all that, but e no go change the fact say the naira dey lose value on a daily. Sombodi say wetin e go profit the naira if e gain all the redesign and lose e value?
As it is, the power to change all these confused geriatrics from power na with our vote. Imagine person go dey whine me say e use not #8bn as was meant to believe but #218bn just to achieve a bunch of turd. So e go beta if we all calm down and think if ways to make the contri beta.
People neva start to dey para, e go soon happen if things dey go like dis. Everything 4 naija na shame and d old bunch of leaders wey we get no go tire or let beta people reach there if people no do something. APC get nothing right 4 their 8 years reign, no be even d mere redesigning of naira note. D thing be like photocopy 4 my eye, photocopy wey dem con mix with colour. This is shameful! I wonder how dem go dey feel if oyinbo people con Naija con dey spend the photocopy...lol. Seriously, I tire 4 dis country.