Omo, like dis everybody dey para for the redesigned naira notes. But wetin I Kno be say wetin don happen don happen. We dey lament say we govt corrupt and all that, but e no go change the fact say the naira dey lose value on a daily. Sombodi say wetin e go profit the naira if e gain all the redesign and lose e value?
You see me para? Nothing concern me with how Naira dey color. Infact I dey accept all colors as normally I no dey discriminate (I no be racist) all colors matas even though na black dem wan do am. We still dey game, we go dey chase the bag until we get that bag wey go make the paper begin chase us back. Wetin dun happen dun happen na to move on as protest no dey work for this country. Normally if na outside and the citizens no like any new development dem go enter street go protest and something urgent will be done about it.
Our own na to shoot us dem sabi. How much self dem carry design this thing but sha wetin we go do, nobi today dem begin thief the national cake. All of dem na the same thing, no surprise them all go shift go labour party or make obi defeat go majority party if him try win and the corruption continues. Cartel man dey wey dey run this country, all this one wey we dey see for front na just film. Every election tym na so dem get one person wey dem go paint as the saviour but as usual nothing come out.