This one na good development as along say na legit. Why I talk so na becasue say, I don too fill online forms wey we Naija government bring. I nor go fit forget N-Power and their nonsense batch selection abi na call up and at the end of the day nothing to show for am. But if this people really dey serious I go follow praise them because na good thing wey e be.
This one na beta info, and it goes well for ear. But based on the kind country people wey we get Dem no go just hijack the process use am do man_know-man tin and end up giving the opportunity to people wey no really get interest n love for this kind tin but just based on the RBS involved only.
Anyway, we just hope it makes sense at the end of it all.