Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Nigeria (Naija)
by
Anguwa
on 27/11/2022, 10:12:16 UTC
⭐ Merited by Marykeller (1)
Blockchain Scholarship for Nigerians

The Buhari government don accept to offer scholarship to Nigerians wey dey interested to study blockchain technology for Nigeria.

NITDA the organize scholarship programs for 30,000 Nigerians. If you dey interested and you wan apply. Make you use this link
https://docs.google.com/forms/d/e/1FAIpQLSdzZ-dOj8idu0DVKAqmNQEzCYz8Hbxddi_sci6vTcljQJWCBQ/viewform

If you wan apply for mentorship for various states, make you use this link
https://docs.google.com/forms/d/e/1FAIpQLSd2SuTr7Io1WlG1E_qSCK9HX-HRB4UfNhQchyAP4Iis3p2glA/viewform

This na positive step by Buhari led government to empower young people for blockchain skills. At least this go transform the country
Na u try pass for dis info wey u bring give us, I de very happy to see this because I don de wait for dis blockchain training wey I get for mind to join, I hope say dem go consider us oo, mek e no come be like say na till u know person b4 u go get slot. But NITD don de run dis kind program for some times now because I no people wey benefit from dem, dem de try give empowerment if dem train u finish, like dis one now, dem fit give laptops self because of practice.
Thanks for d info @Marykeller.