Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Frankolala
on 27/11/2022, 14:30:33 UTC
My qualms with the redesign of the naira is not even about the security purpose but how does this redesign help the economy?

We fit no see the relevance of it to the stability of the economy at once now but make we tell ourselves the truth, as CBN announced deadline for the old notes to expire and those weh pack money keep for house begin bring them out shey we see how the naira begin get strength? From wetin I read online from the office of the CBN, the money in circulation deh below half of wetin e supposed be self. Politicians them pack money keep for house, waiting for the election next year. And that is why banks go tell customers to wait for cash when you want to make heavy withdrawal say cash never deh. We deh think say no scope but na true. Now enough cash don enter circulation.
I agree with you bro, Nigeria Politicians dey thief money dey hide for house,inside coffin, inside well,sucker well and even bury money. Imagine  wetin dem dey do our economy. Money wey people suppose to dey use for business so dat e go born children,na e dem imprison cum make people dey suffer. This recent flood wey happen one commissioner die for Bayelsa due to Cardiac attack becos say e hide money inside room  before e go carry him family go Abuja for safety from the flood,for Abuja na e him hear say flood don reach e house before e go come back to Bayelsa flood don dey window level of e house,all the money don cast. Na wetin lead to him death. So the redesign go help small