Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 6 from 3 users
Re: Nigeria (Naija)
by
Cryptomiles1
on 27/11/2022, 21:28:09 UTC
⭐ Merited by CryptocurencyKing (2) ,Hyphen(-) (2) ,Cynthia_sinach042 (2)
See ehh naturally self me really like the update wey be say all those money wey those criminal them loot go waste based on the new rules wey them set and like this any careless move na efcc straight go knock for their doors so e no too dey pretty cool with politicians. Although them fit still disposed all those money wey dem look though because them get connect onto say them go still carry B'Van enta where them hod am go bank pay put into one business account say na contract be that na so e be and no case.
Now upon that man wey die for BY onto say him money soak for water, omo e touch because e fit be like say na him live savings be that and e reach to die.
RIP to him.