Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Coyster
on 28/11/2022, 09:18:32 UTC
Anyway for all my people wey dey Lagos and Abuja looking for job's to use survive and hold urside, make una follow this link for daily legit job updates wey Dem the drop both on Whatsapp and telegram too. It bad say person don finish school but no beta job yet but for now make we de manage the little ones we see for a start na so life for we country just be.
https://chat.whatsapp.com/LfUMpz165EcCNrO1kQUkdd
Thank you for this update brother mi, i they plenty of this kind group, both for whatsapp and for TG, my guy the matter they discouraging like mad, you go see job description, specification and roles like this ehn, them go list heaven and earth for there, ask you for crazy work experience wey fresh graduate no fit get, some go even talk say you no suppose dy older than 26, guy the matter go just weak person, but you know wetin come funny pass, aftee them list all these things, you go come see salary range: 75,000-85,000 per month, na that one go just kill your morale. Grin That is why everybody they find their own way based on self employment, business and investment matters oh, because e no easy to work for person like slave come they collect money wey no go do you to chop for one month. God go help everyone of us here, and provide for us too.