Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
RockBell
on 29/11/2022, 21:01:58 UTC
Blockchain Scholarship for Nigerians

The Buhari government don accept to offer scholarship to Nigerians wey dey interested to study blockchain technology for Nigeria.

NITDA the organize scholarship programs for 30,000 Nigerians. If you dey interested and you wan apply. Make you use this link
https://docs.google.com/forms/d/e/1FAIpQLSdzZ-dOj8idu0DVKAqmNQEzCYz8Hbxddi_sci6vTcljQJWCBQ/viewform

If you wan apply for mentorship for various states, make you use this link
https://docs.google.com/forms/d/e/1FAIpQLSd2SuTr7Io1WlG1E_qSCK9HX-HRB4UfNhQchyAP4Iis3p2glA/viewform

This na positive step by Buhari led government to empower young people for blockchain skills. At least this go transform the country
This one na good development as along say na legit. Why I talk so na becasue say, I don too fill online forms wey we Naija government bring. I nor go fit forget N-Power and their nonsense batch selection abi na call up and at the end of the day nothing to show for am. But if this people really dey serious I go follow praise them because na good thing wey e be.
Has I they look this matter now I love the idea, the government having an interest in blockchain to extent of giving out scholarship to 30,000 nigerian, I pray make he legit because nigeria government and fake promises, me self register N power but till today I no see anything and I they hear say people get, I go drop my application now self for the link make I go add more knowledge, I wonder why na now them they bring such development to our table, I go sha still apply.