Post
Topic
Board Other languages/locations
Re: African Proverbs in Pidgin
by
Mpamaegbu
on 30/11/2022, 04:02:55 UTC
I just dey reach here now and I don dey para say I don miss plenty tori and I don take time read plenty parable fr here wey I don laugh tire.
I see say our eldest elder wey be@ Mpa dom pour you holy water no worry more go reach you as you continue to dey sit down wia elders dey.
Dis guy sef, you nor go kill persin here sha 🤣 wit all these ur accolades. Anyway, it goes well sey dis owa corna dey enlarge small small as more people dey fall in. Nothing wey pass unity in numbers as owa people dey talk sey if dem join join piss for a particular spot e dey bring foam. Na so we go dey do here to bring joy and betta wisdom to owaselves. One luv!