Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
CryptSafe
on 30/11/2022, 19:16:30 UTC
Anyway for all my people wey dey Lagos and Abuja looking for job's to use survive and hold urside, make una follow this link for daily legit job updates wey Dem the drop both on Whatsapp and telegram too. It bad say person don finish school but no beta job yet but for now make we de manage the little ones we see for a start na so life for we country just be.
https://chat.whatsapp.com/LfUMpz165EcCNrO1kQUkdd

Beware of scammers, Nigerians have not matured enough to control or provide jobs like advance countries. In advance countries private companies which are meant only for employment and hiring of workers are always on the peak. But in Africa (most in Nigeria), scammers stay behind the companies to scam people. From the link you provided, I am not really sure that, it is a legit company. Legit companies create website before social media and not social media first. Now when you join the WhatsApp group how do you get a job. It is through any link provided by anyone in the group, admin etc. Which has no direction and it will lead to scamming. I am a well experience person in such scenario. I have been scammed by such groups and platforms.

Forum users be warned when applying. Scammers can use different dimensions to get money.

You are correct. Most of these scammers now din graduate to higher level of scamming.  See the matter be say na desperate Nigerians dey fall victim because Dem need the job main. You no go blame them Sha because this government don frustrate the youths wey be say Dem no dey reason matter well again. Any thing employment or vacancy Dem take eye see Dem go shook head put without conducting due diligence to know wether the vacancy or job offer na true and genuine one. You see this group wey then put here so, you no go vex for the person wey put am o because wetin me I see be say the person just want to help matter make e be say people wey get job offer bring am come the platform make e too for help others wey dey look for job get too but the truth be say some people wey Dem work na to dey scam person go hijack am begin use dey scam people wey no go at all. My own advice be say ehn make every body wey join the group open their wide their eye o make Dem no chop Dem don't tell anyone.