Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
CryptSafe
on 01/12/2022, 11:55:51 UTC

Again, politics na very emotional something so make we no take anything too serious, make we just understand say na vote we dey go vote and no kill ourselves in the process. I just dey pray say anything wey make Obi win, I use Jesus beg God make him help am make him get positive impact because if Obi fuck up as Buhari dun fuck up after many youths support am then We go lose many interest of the youth in politics and Nigeria go come finish finally.

Politicians in Nigerian generally are evil, like na only their own interests they get at heart no mata how dem behavior, the end goal na to get themselves on the seat and that's all. Most of them, immediately they enter them dun forget everything dem promise but I hope this time around things go different. Actually if we dey fair, non or them deserve to rule this country but as we can only work with whatever we have, then we have to select one and hope for the best.

This talk na true about dis our country politicians all of them  just dey after their own interests, the Time wey dem Neva enter the seat na so dem go dey give empty promises about making things beta for this country but the moment dem enter every thing don change and the most interesting part of the time election be say ,OK everybody dey support obi but even if obi cum win now owna forget say na still the same set of  evil politians wey dey for the pdp and apc nai go still run come enta the labour party wey win and the same appointment of ministers and senators go still circulate round and this same problem of corrupt leaders go dey on . The fact be say only obi no go fit change everything for this country oo. everyone needs to change their mind set on things for this country

Comrade, the matter sef tire  person no be small but the truth be say ehn na we dey do ourselves all this wahala. You go see say the same youth wey dey shout say Dem no want again na the same youth go vote them out come election after d don collect money and rice. Until we stand up to say no make them carry their money and vote buying go we no want again Dem go still dey for corridors of power. E no go make sense say after over 18 years of democracy the matter still remain the same come even worst pass as edey before democracy. As edey so I  dey think say the previous pattern of government don better pass as the Democratic system of government be now. Na only God fit help us for we country.