The more you people talking about not being sentimental, tribalistic and whatever, the more I see sentiment and all you mention in the statement. PDP has ruled, yes! But was it Atiku that ruled? No. APC also, it's not Tinubu that is ruling now. Obi was the part of the PDP that ruled before. He's not Saint as you all portray. Na sentiment sef dey make us support Obi all in name of na Igbo turn and nothing more. If we are to be fair to ourselves, kwankwaso and Sowore are better choice too but sentiment no go allow us to see.
No be sentiment make me deh support Peter Obi unto say na Igbo person. Carry Orji Uzor Kalu or Dave Umahi put there and watch how many people from the east weh go support his candidature. Many people deh support PO because say na him deh transparent pass among others. Sowore also deh good but his ideas no go too work except if majority of those lazy legislators weh deh National Assembly na people weh support am, to allow his policies go through. We sabi how those NA members don cast this country because of greed and them no go want to support Sowore policies weh e go be say e go go against them. Tinubu weh you mention for deh ok to run in 1999, 2003, 2007, 2011. Then he was active and healthy. The Tinubu weh deh now deh very sick. He will make us laughing stock abroad in the midst of other presidents. The man has dementia already abi una no deh see am?
I for like shook mouth for this matter but your reply don already do justice to wetin the user talk. Well done. Make we still talk about bitcoin and bitcoin development for Naija because whether na Peter Obi win or na Atiku or Tinubu, if we nor hustle hard nobody, not even their proposed policies go fit help us.
Abeg I wan ask anybody here don notice say Remitano dey freeze or e dey too slow? And which other alternative dey aside Binance wey person fit to use? Una Doh