Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Nigeria (Naija)
by
Lida93
on 02/12/2022, 17:46:05 UTC
⭐ Merited by CryptopreneurBrainboss (1)
Quote from: Majestic-milf
E dey pain me say up till dis time, we still get pipo wey dey sentimental about this election and d candidates
E good say we sopoz vote who go carry is jakpa from dis mess wey our past leaders and current leader keep us, but e no go make sense if we dey particular about a candidate, because if no be God wey help, we fit still go vote another wolf in sheep's clothing.
Wen, I no say Nigeria will definitely get it right this time because nobody is voting because of region like wat ur leaders used to deceive us those days that if d person win will convert everybody to christian or Muslim. If u no the population of people that came out few months ago to register for voter cards, you will no dat Nigeria is very ready to correct some bad things to good things in ur nation Nigeria so that ur leaders will start carry citizens like eggs.
Any how tins be for now, me I still get the hope say naija go beta cos gradually the level of political consciousness and participation among our young and old don the increase pass befor befor. And all we dey pray na make baba God hep us mk we get the beta leader wey really get naija development for heart.

Like dis I wan use this opportunity call on all my brodas and sista Dem inside the forum to join me celebrate as today na my convocation for the university of Port Harcourt wey mark am say true true all don really don and dusted. The journey be no easy but baba God make am possible

https://i.imgur.com/wxjJoXe.jpeg

As baba do am for me na so him go run am for every other person in their own different expectations.