Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Wiwo
on 04/12/2022, 14:56:05 UTC
Nigerian crypto exchange Quidax lays off 25% of its staff
Did they spend too much on BBN sponsorship and other ambassadorial deals? What do you think?

Misplaced priority, why dem go waste that amount of money dem put for those sponsorship, wetin e do for them abi dem no know say Nigerians typical dey like use foreign things instead of the locals because of the fear of been scammed. No how dem go tell us say dey never broke and make people watch out oh before we get our own Nigeria FTX. If anybody get funds for that exchange den withdraw now or avoid usage for the maintime. See how the storyline they first, first dem go say the bear market no affect them neither did any recent collapse or crash of a popular project wey many other smaller project dey get investment in.

Then the next thing them shutdown withdrawal and before you know na bankruptcy story you go dey hear. How person go just wake up sack him workers when productive dey high and profit dey come in. Dem no get money make dem no dey lie. Anybody wey get their contact make una tell them to come take loan from DarkStar_  oh (lol) before dem go fall our hands.
Abeg CryptopreneurBrainboss Darkstar dey give bailout for country I wan make 9ja government come take a loan to run 2023 election, 😆 lol. Quidax na one local exchange were I dey like use because of the transaction speed but as things dey go like this, every exchange na suspect.
That being said, laying off of staff is mostly due to low revenue or unseen events such like the FTX crash, but for quidax to mentioned that their exchange revenue was not affected by the FTX crash is what I found as an untruthful statement. because even though the FTX situation did not affect their funds directly, it has affected the entire cryptocurrency market and the revenue for all projects have dropped significantly due that so quidax should man up and say the truth to gain users trust going forward but until then baba I don japa from quidax for sometime, abi if quidax run with or hold my deposit I go collect am from Don Jazzy from the money they pay ammm for sponsorship?  Grin Grin Grin