Government wan begin dey tax crypto transactions
My people I listen to channels TV and them report say the government dey look into taxing crypto transactions and digital assets. Madam Zainab wey be finance minister say the go go through FEC before the president go forward am go Green and Red Chamber for approval. The way things they go recently he be like we government Don dey fall in love with crypto oo abi dem just dey feel say no matter watin dem do people no go leave the crypto so themselves they follow trend.
Abi them wan use this one take consol Nigerians base on election wey dey come? Since plenty youths dey into this stuff.
My people I wan here una view how una see this move?
Nothing wey Nigerian government go do wey go surprise me again, e fit be say, dem see say people no wan live d cryptocurrency na why dem wan legalise am make dey get small money 4 people wey de involved in Bitcoin and cryptocurrency transactions, and e fit be say dis party wey de rule wan catch youth attention as dem see sa youths like Crypto wella.
Moreso he be like dem NITD Don shortlist people wey dem carry for this blockchain tutorial dem. If you apply just check your mail to see
Good luck 4 people wey dem carry, I hope say dat one na way to Bitcoin legalisation in Nigeria.