Government wan begin dey tax crypto transactions
My people I listen to channels TV and them report say the government dey look into taxing crypto transactions and digital assets. Madam Zainab wey be finance minister say the go go through FEC before the president go forward am go Green and Red Chamber for approval. The way things they go recently he be like we government Don dey fall in love with crypto oo abi dem just dey feel say no matter watin dem do people no go leave the crypto so themselves they follow trend.
Abi them wan use this one take consol Nigerians base on election wey dey come? Since plenty youths dey into this stuff.
My people I wan here una view how una see this move?
Moreso he be like dem NITD Don shortlist people wey dem carry for this blockchain tutorial dem. If you apply just check your mail to see
Dis won na gud won bcos e bi like sae di Government have it in their mind even though dem neva approve am. But how dem wan do am wey bi sae dem won create jobs from crypto through taxation. Di mata tire me. Onli dis year dem don promise Nigerians on cryptocurrency plenty times but nothing don Happened. Di thing don enta politics.