Government wan begin dey tax crypto transactions
My people I listen to channels TV and them report say the government dey look into taxing crypto transactions and digital assets. Madam Zainab wey be finance minister say the go go through FEC before the president go forward am go Green and Red Chamber for approval. The way things they go recently he be like we government Don dey fall in love with crypto oo abi dem just dey feel say no matter watin dem do people no go leave the crypto so themselves they follow trend.
Abi them wan use this one take consol Nigerians base on election wey dey come? Since plenty youths dey into this stuff.
My people I wan here una view how una see this move?
Moreso he be like dem NITD Don shortlist people wey dem carry for this blockchain tutorial dem. If you apply just check your mail to see
You see this our present government, no belief any wey d sae until the implement am immediately. Shey you been see how the take ban trading crypto that year with banks. You see how the take announce am that day for news, the next day d implement asap. Why don't they do the same with this one now? They wan try to follow the duo process to implement am. Make em be as if dem no d against crypto. It's remaining 2months to the end of their tenure, they wan to the try form good make people clap for them. Abegy make them shift one side, make we see wetin our next President gets in stock for Nigerians.
Me wey share the information about NITD I no get any email sha

anyway congrats to people wey receive the email from them. I wish una luck