Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
uchegod-21
on 06/12/2022, 19:15:26 UTC

Top 30 active users in NOV 2022 extended.

1. Agbe [29] 5 Merits awarded
2. CryptopreneurBrainboss [24] 0 Merits awarded
3. Marykeller [24] 3 Merits awarded.
4. Maestro75 [22] 2 Merits awarded.

Congratulations to Agbe, CryptopreneurBrainboss and Marykeller. I also congratulate every person wey their name enter for the list. E good as here dey grow day by day and the whole community dey acknowledge say we dey try.

onward only 7 political posts will be counted per user for the Merit award

I just see poll wey dey ontop this our thread. I no just like that poll at all. This one or two rules we wan introduce no go help the growth of this our local board at all. Now wey the spirit don high, na em we wan come dull the spirit? Our page for this thread never even reach common 300pages, our activity still dey low and we wan introduce rule wey go discourage people to post.

We never even get our local board we don already dey discriminate some posts as low quality. We fit no understand wetin wan happen, but I don see am say e no go help us at all. E no compulsory say na bitcoin we go dey talk here.

INFACT, MAKE I CLEAR US, no bitcoin we go talk here wey go make sense pass wetin dey go on for bitcoin board. People wey dey take bitcoin serious for their local board na people wey no dey understand English.  We here dey understand English pass pidgin sef.

If you check well Theymos himself no dey add anything wey go limit anybody. And I suggest say make we no suffocate here with rules.