Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
RockBell
on 06/12/2022, 20:24:45 UTC
Government wan begin dey tax crypto transactions

My people I listen to channels TV and them report say the government dey look into taxing crypto transactions and digital assets. Madam Zainab wey be finance minister say the go go through FEC before the president go forward am go Green and Red Chamber for approval. The way things they go recently he be like we government Don dey fall in love with crypto oo abi dem just dey feel say no matter watin dem do people no go leave the crypto so themselves they follow trend.

Abi them wan use this one take consol Nigerians base on election wey dey come? Since plenty youths dey into this stuff.

My people I wan here una view how una see this move?


Moreso he be like dem NITD Don shortlist people wey dem carry for this blockchain tutorial dem. If you apply just check your mail to see
Looking at waiting they happen currently for the world, seen countries like el Salvador and brazil wey don adopt bitcoin na good thing so I feel Nigeria government is already having a kind of interest or I don't even know, but if our government give it a try no be bad thing and deep down them ma know say them no fit stop boys from trading that one they sure , since the citizens done see am as a way of empowering their self, like the popular saying if you cant fight them you join them.