Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
DaNNy001
on 07/12/2022, 12:02:02 UTC

As CBN wan limit daily and weekly withdraw of peoples funds, make them know forget the high increase of goods and service for the country. At least when person do his or her daily withdrawal of 20k em go do am for em household.

Omo this kind condition no bam at all. To every problem, there's always a strategy to solve am sha. I trust Nigerians. Wey go find ways to beat their 20k and 100k daily and weekly limit.

As CBN don introduce this new law, will it be a continual process? Cos Nigeria government no d do anything like continuity. The next government go fit enter now, come dissolve everything and also appoint his own CBN governor join. I know Naija my country.
Omo dis country na wa oo. All this politicians wey deh try to amend the country like dis well from one view e no bad oo but as merrykeller talk am omo make we check out the disadvantage na 20k a day when you wey be family person wan go market with all other expenses 20k no go do anything for this high cost goods and services in the country.

Omo even to pay some kind things online sef go come become problem for people and i get the move wey dem deh try take but nothing dey eva work perfectly in the country so in due time anoda update on the way to tackle this go come.
Them ban bitcoin but e no stop us to deh still dey trade bitcoin and this update go even worry business men and women wey deh operate POS service well well and most youth sef for this Nigeria na this pos business deh sustain dem.