New CNB 20k daily withdrawal limit
As CBN wan limit daily and weekly withdraw of peoples funds, make them know forget the high increase of goods and service for the country. At least when person do his or her daily withdrawal of 20k em go do am for em household.
Omo this kind condition no bam at all. To every problem, there's always a strategy to solve am sha. I trust Nigerians. Wey go find ways to beat their 20k and 100k daily and weekly limit.
As CBN don introduce this new law, will it be a continual process? Cos Nigeria government no d do anything like continuity. The next government go fit enter now, come dissolve everything and also appoint his own CBN governor join. I know Naija my country.
Na wah o,from frypan to fire,hardship dey everywhere wey be say we need circulation of funds so that the money go dey everywhere, instead them won limit the quantity from people again. I no see how dis 20k max withdrawal won take stop corruption o,instead e go worsten the country hardship and insecurity.
Politicians go always dey thief becos na only through dat stealing dem fit use live luxurious life,instead of to dey carry money put for bank,many of them go adopt the old system to begin keep money for house. This new law go fit wreck banking business o,becos many pple no go dey go put money for bank again. This go lead to insecurity becos arm robbers to come begin go dey rob pple for their house unto say dem know say money fit dey house.
Na only crypto business men and users na dem dis law no go affect especially if na for goods and services. I guess say dis government know wetin dem dey do,maybe dem won use am choke politicians for this forth coming election so that shortage of money to sponsor their electoral malpractice no go dey enough. This our government no get anything to offer,recently dem change the currency,now limitation of withdrawal, na mago mago tin don involve,no be for Nigeria betterment.