The idea behind this is to encourage more non political discussion but not to stop it.
ahm boss you try well well, i like this ur style at least make we reduce politics mata anyhow we talk am here e no go solve any problems rather we dey open our yansh dey give outside to dey look dey laugh us. If na only me self anytin politics no suppose come here again but announcement and important updates just like this CBN wahala dem fit post am but anytin APC, PDP, LP no suppose come here bicus i know say we get different pipo wey dey dia party and wey no go like any silly talk from anoda pesin to talk again him party so all dis tins fit bring beef and little hatred so as 001 wey you be i like as you reduced the talk them to dat number you put for pull. And if u look well dis politics talks dey cause spamming too much from people here just becus una set merits so dem go wan carry am spam here so dat dem fit gain merit wen month end so i go suggest just stop de merit and you go see say politics matta go reduce as well.