Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
EarnOnVictor
on 08/12/2022, 17:34:33 UTC
The goal of redesigning was for security reasons; most of you are missing the point of the entire project;

No be lie you talk but nobi Nigeria we dey. If you make all the money wey politicians dun steal useless, that one no go just make dem still more next time they get the opportunity and this time around dey go comot the money for naira carry am go dollars and that way talking money out of the economy instead of putting money through investment in the country. Same thing goes for the money obtained through illegal means, this one no go just increase the security threat of the nation making kidnappers going back to their old ways to demand ransom and causing nuisance.
As I no like Buhari government and Emefiele as the CBN governor reach, wetin dem dey do 4 dis later time good. D Naira designing na project wey don overdue, nothing bad dey am but d timing wrong. Even as people dey doubt am, I know say no matter wetin their agenda fit be, e go soon clear. But d latest limiting of cash withdrawal circular further show say Buhari and CBN no get hidden agenda as d tin go affect everybody. Na senate and house of rep we suppose dey beg now because the development coupled with the redesigning go affect politicians and counter many menace wey dey affect naija. So dem go wan fight am.