785 Merits in one Year
I no wan tok too much again bcoz I don already tok everything in
here. I say make I drop am here make my pipo also see di achievement.. really it is not easy. I may say I was won of di most criticized pesin in di forum but I tank God for everything.
My special tank goes to My BOSS
SMARTVIRUS who encourages me to this far. And also to Igehhh, CryptopreneurBranboss and Kenny who instructed me how to deal with one of my most criticized thread dat was sent to archive.
I tank all of una. U fit do am... don't imitate, always bi an original poster. 💪
This na the best achievement wey you achieve for this year, and na becos of your effort and loyalty to pple for the forum na e make God come lift you up. I say make I congratulate you for your good work wey u dey do for the forum. You be my senior man and I gbadun your ginger wey u ginger yourself to get 785 merit for 365 days no be beans or bobo juice.
This na to encourage pple like us and d newbies say light still dey at the end of the tunnel if we fit endure follow up and learn things for here. We suppose celebrate this one Agbe,abi wetin you think since you don turn Nigeria Fillippone. I wish u the best for everything wey u put your hand since God don already bless you no man go fit change am.
I beg make una no vex o, I remember say our noble Boss for here Brainboss,when world cup just start e bin ask say na which club we go support and I remember,I say I no know who to support becos the game never mature. Now na quarter final and I believe say everybody don get him country wey e believe say go fit carry the club due to their performance for their previous matches.
I go say Brazil and France fit play finals and presently na these two countries na dem I dey support,but I want make Brazil win France for finals becos I no want back to back.