Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
sokani
on 08/12/2022, 21:39:07 UTC

I trust naija na the politicians wey don see the disadvantages for their side don deh try to stop the c.b.n from implementimg this their cashless withdrawals but anyway sha before the house of rep dem don summon the  cbn governor  nai be say the matter don really serious for the house be dat. 

Nigeria na one kind funny country wey this our politicians don spoil am go far for us and anything wey don spoil like this e dey hard well well to amend so all this amendments wey the cbn governor they try to do go fit affect us bad bad oo but maybe e fit even help give this our naira note small value. Just imagine even the ghana cedis wey our money been big pas sef don get value pass our own.

No mind our politicians na wetin go favour them na him them dey interested in, although them dey say e go effect small scale businesses which is very true but the advantages out weights the disadvantages. The new policy no talk say if you want buy car, house or goods of 5 million and above, u no go fit cuz u can always do a transfer with your phone, POS, ATM machine, and bank.

The main reason why dem kick against the cash withdrawal limit na because of the forth coming election. Because if this policy take effect , e go really affect them well well as them no go fit get hold of enough cash wey dem go use they give 2k to voters for polling units during the forth coming election.