NEWS UPDATE: House of reps orders CBN to halt new cash withdrawal limitFollowing the announcement wey CBN make, say dem wan limit the withdrawal of cash to N20,000 daily and N100,000 weeky for individuals and N100,000 daily and N500,000 weekly for organisations wey suppose take place on 9 Jan 2023. The house of reps no gree at all about this recent infoment, and as a result them don order CBN to stop the implementation of this new policy and them don send the CBN governor Godwin Emefiele letter make him appear before the house on 15 December 2022, make him come torchlight about the new policy and tell them why dem go allow am to stand.
https://community.thenationonlineng.net/forum/breaking-house-of-reps-orders-cbn-to-suspend-new-cash-withdrawal-?xg_source=twitter The wan wey make me laff nah say the house of Reps no know how the redesign of the naira take dey funded. Nah just me or nah say we politicians dey use our heads? How dem go say them no approve the expenditures, then that means em go over their heads do am? Sha na their meeting next week go tell
This news na true say house of rep no know say that kind limit withdrawal don take place. Na wa o Nigeria, na she be d only country wey say e dey practice federal government but no dey practice the law of federal government. Who be CBN governor wey go just sit down for e backyard or for beer parlour plan wit e criminal politicians to put max withdrawal as 20k without the house of rep notice.
All these things na e dey tire me for dis people dem just dey do anyhow for the seats to favour themselves and not after me and u wey be d common man. Na e make dis country problem dey worst becos dem no dey do the right thing which means say all of them no dey competent enough to pilot the affair of this country.