Senior member
Em no go make sense if keep this news to myself without announcing here. I no sae it is no longer allowed to post new rank position for here but make una permit to do so.
First of all I wan thank God Almighty for the life and health, for giving me able friend and well wishers like una. Friends and boss like CryptopreneurBranboss, BitBender, Upgrade00, Asiska, and so may others wey challenge, boost my morale and encourage me to this level wey I reach so. I sight and greet una
I wan tell the upcoming members sae, no limit of rank dey impossible to reach, 4months ago, I d this forum as a member rank, but see where I d today. If I can do it, you too can do it also. Just believe and push harder to be a better poster
Omo congratulations to all our Nigerians people wey deh progress well well for this forum e no easy to attain such heights in just few months. weldone to agbe and to marykeller and everyone wey follow support this achievements.
As you talk am na so e be say no rank wey no dey attainable for the forum so far as you are willing to learn and then put all your efforts to post quality things you go make am for the forum. Most of us wey be newbie for the forum make we just dey hang on to wetin we dey do so matter say na legit we go reach were we dey go and one thing wey i come like this forum be say no body fit fast pass him shadow so everything na time for the forum so if never reach ur own just calm down and dey wait just be an original poster and oluwa go run am for you.