NEWS UPDATE: House of reps orders CBN to halt new cash withdrawal limitFollowing the announcement wey CBN make, say dem wan limit the withdrawal of cash to N20,000 daily and N100,000 weeky for individuals and N100,000 daily and N500,000 weekly for organisations wey suppose take place on 9 Jan 2023. The house of reps no gree at all about this recent infoment, and as a result them don order CBN to stop the implementation of this new policy and them don send the CBN governor Godwin Emefiele letter make him appear before the house on 15 December 2022, make him come torchlight about the new policy and tell them why dem go allow am to stand.
https://community.thenationonlineng.net/forum/breaking-house-of-reps-orders-cbn-to-suspend-new-cash-withdrawal-?xg_source=twitter This na very interesting topic we don dey discuss here and I don read many people opinion. But e get wetin I discover for Nigeria. Anything wey happen, we must take side whether we understand the benefits or not. Especially when we no trust government because of their incompetence, anything wey dem do no dey sweet us.
But me dey always analyse the matter without hatred or bais. That was why I no dey against the redesign of naira when the news been come out and we later see the impact.
For this matter, house of assembly no get our interest for mind. Make dem getawt. Since we kerosene dey expensive dem don debate because of rural people? Na cash withdrawal wey dem wan use rural area dodge bullet?
Me I believe say everything get the good and bad side of their existence. You see this new withdrawal policy mata, e actually make sense say CBN do am like that this period wey be say election dey near make dem checkmate to see the in and out flow of money from banks and know how e dey go. Our national assembly dey para because e affect them onto say dem no go fit withdraw huge cash from bank again to do their runs hence dem dey summon the CBN governor to come answer them. I just pray the CBN governor no answer dem at all. Make him for just continue with him work without any fear or favour. This policy no too much affect the masses because of the current economic situation as everybody don dey mind their expenses and expenditure but atleast, the policy go help this festive season make person to too no dey spend to much