What is the impact of the limitation of the daily cash withdrawal to bitcoin ? This has a direct effect on bitcoiners in Nigeria, since bitcoin can't be used without the Fiat currency in the country, and if you want to but plantain of 30k and the seller is using the cashless transaction system, what will you do? And also has an advantage to bitcoiners, because since we are familiar with the online transaction, the cashless system will favour us but what market pipo?
You no need to bother yourself too much about this matter my guy, if dem implement dis then even the market people go improvise, na because dem never introduce am you dey reason say e go hard. Even person wey no go school now fit operate and use ATM machine. Before dem introduce am for even civil servants to dey collect money from bank instead of table payment dem been grumble but now dem prefer am like that. Anything wey person put head say him go do, e go definitely work out like that. Make we just dey watch see how the matter go be after dem implement am because I no see any reason wey dem go stop am now since e don reach dis stage like dis.