I.e imagine you want to buy a car of one million naira, that means as an individual, you have to wait for good 10 weeks to complete a transfer of just only one million naira (#100k weekly). Too bad.
Mate, the policy e no dey like dat. Na only cash withdrawal is limited to 20k on ATM while inside Bank is 100k or individuals but for organizations and companies can withdraw from 500-1m. Apart from the daily cash withdrawal limit. You can transfer any amount of money to another person through e-transaction. They are trying to establish and also trying to make the e-naira more stronger and appreciatable. The limitation of cash withdrawal will affect everyone. But will affect POS more because 100k per day can not even up one family expensive, only one person nao go come collect the money and go home. And that day business e don end till the following day. And HOR can not do anything because Buhari is backing them.
D issue be say people dey react before dem think, I no know wetin dey worry our people as wetin we need 4 our economy to grow, fight against corruption, money laundering, vote buying and many more translate to bad thing. Limiting cash withdrawal no translate to stopping you from spending your money, e go only increase accountability electronically. I no know wetin person wan buy with cash wey N100k no fit buy weekly, and if e no fit buy am, make d person do transfer. Even 4 local market, I dey do transfer for goods less than N2k, so wetin con be d big deal? CBN no dey hold anybody moni.
Anyone wey dey fight dis withdrawal limit is either ignorant or be enemy of progress bcos dis no go affect anybody badly. Even d POS people wey dey talk, special package dey 4 dem, but it must be properly documented. And our senate/rep wey dey talk, na their self interest dem dey fight for, e no go be business as usual 4 dem, but nobody fit missout 4 dis, not even d rural area people wey CBN don engage 1.4 million super agents to cater for.
Make everybody save their weekly cash of N100K for small spending and transfer for higher spending, simple!