Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Maestro75
on 14/12/2022, 08:06:27 UTC
Boss just incase una still dey debate this matter see my bank don send me email and it's really disheartening how this people no dey even consider the common man

Na now I confirm say una get money for this country no be lie. If not how 100k weekly limitation go worry una. Me self I no deh do reach 100k weekly. Where the money even deh to withdraw self. How many people deh even earn up to that amount as salaries self for this country, even graduates? My concern na whether CBN and its partners go make the rule deh for everybody, no be only for the less privileged.