Sha make we dey watch how things go play out but I believe go get an right this time.
I believe say we go get am right too, Make INEC just try their best make the election dey free and fair, make we see truly who Nigerians want to rule them. E sure me die say some candidates for Nigeria nor want free and fair elections and dem go try all their strategy wey we know including new ones wey we never see before to take try make sure say everything favor them.
To get better election depends on us wey dey vote, make we nor just go vote then start to go house, you need to also defend your votes and ensure that the votes are collated correctly with any obvious mago mago. E go also depend on INEC say after people dun vote finish, stay to count am correctly, then dem cun dey do wayo later, I hope say dem go play their part well in ensuring a free and fair election.