Collection of PVC for the 2023 general elections. source:https://www.premiumtimesng.com/news/568710-inec-announces-dates-for-pvc-collection.htmlThe Independent Electoral Commission has commenced the issuance of the permanent voters card PVC for those individuals that did their registration in this year 2022, from today 12th December to January 22nd, 2023. We're all encouraged to go the commission office in all our local government areas or wards to collect our cards through Mondays to Sunday's 9am to 3pm.
This na one thing wey I dey like Nigeria for, we no ever dey get deadline as new new deadline they always pop out at anytime to make sure the masses dey satisfy. This one na welcome development as plenty people never do their PVC and this new deadline go help bring out some new voters. We need the masses for this election or e no go go as we dey expect. Also make INEC also dey at alert as this opportunity wey dem open so fit dey used wrongly by politicians wey wan buy their way into position.
Make dem no go dey approved underage votes now or do wrong PVC for politicians as we dey normally hear the story after election wey we go see dozens of PVC wey dem throwaway. I been hear story for radio wey INEC people talk say politicians dey put them under pressure to make them rig this election. I hope this one no follow reason why them reopen the PVC mata so them fit use am achieved their rigging. Sha make we dey watch how things go play out but I belivyww go get an right this time.
Senior Comrade this matter wey you raise like this no be small one o. You see this issue of under age voting naim be the problem INEC need to look into because as the matter be now ehn na the strategy our northern politicians dey use very well dey take win election. If you go remember the last general elections wey happen for Naija here na wetin dem use wella take win election even international observers wey dey ground too confirm to say na true say na wetin happen wey dem too witness. You see ehn this opening and reopening of voters registration and collection somehow too fit be strategy to confuse and distract the masses from knowing wetin dem dey upto. No be new thing o. E don happen before na same strategy dem use wey we no know and na same thing too dem want to do again. E go bad say we don know wetin dem dey do to take win election we no do anything about am. We just keep quiet seat for fence dey look dem as dem take naija dey play football to their own satisfaction.