Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Frankolala
on 16/12/2022, 20:47:39 UTC

Make dem no go dey approved underage votes now or do wrong PVC for politicians as we dey normally hear the story after election wey we go see dozens of PVC wey dem throwaway. I been hear story for radio wey INEC people talk say politicians dey put them under pressure to make them rig this election. I hope this one no follow reason why them reopen the PVC mata so them fit use am achieved their rigging. Sha make we dey watch how things go play out but I belivyww go get an right this time.
Make we dey see na. This country na very funny place because this election wey deh on ground na the one chance wey we Nigerians don get again to correct all this nonsense of a bad leader wey deh happen to us but the top people dem no go want make our votes we go cast make e deh line with the constitution and in line with the results wey come after the voting. I know e deh easy for the inec people too but make dem too try their best to help this country make we fit fo legit some for once, the rate of underage voters for the country especially for the northern part e too much and this politicians wey deh involved for this election make dem understand say the position of being a president be na you deh serve the Nigerians no we deh serve you.

Comrade, you see this matter as we dey talk here, i just realize one thing though, if e dey possible say the office of the inec chairman go dey void of appointment from the office of the president, e for better make e be say na merit in promotion as na another powerful government parastatals be that because na dem dey usher in new government. But as e be now the way dem don dey run paroll with that agency now ehn na every government with him conman wey go run the office to  sustain am for him two tenure for office  so that nobody go fit do any how during election to remove am from office whem him two tenure never complete.  Me i just think say we need to look into that area too because that office na another wahala wey we dey face for we country naija. How una see am na?
I don collect my PVC so that make I know say I follow for the waka to commot bad government and leaders for we country. At least even though,rigging of election take place and my candidate no win,I go still dey happy so I try my best but e no work.

My advice be say get your PVC ready because na wetin politicians dey use rig election by doing PVC for underage and  hiding the opposite part members PVC,if them see am for INEC office. For Nigeria to get good leader na me and you hand e dey. This na wetin people no know before but now their eye don open. No be to talk na to take action.