NEW TOPIC
Username: Resident coin
Gender: male
Skill: student
State of origin: Akwaibom state
I dey very happy to see my fellow Nigerians here,I be newbie for here and I know sey many of you don master this forum. I just wan make we dey together as brothers and sisters, I hope say I dey welcome and we go make a good team??
Regards
My broda,u r welcome to our local board,e good as u come identify yourself with us,na with our two hands na e we take welcome you.This board na nice place wet u fit ask any crypto related issues wey u won know as we get our big oga dem wey go tell you wetin u won know.
Take your time read more and make u no go do copy and paste work o becos this one na the number one offense for the forum wey go lead to permanent banned. E no easy to rank up but with God everything dey possible so make u take your time study and make research on your own to help you grow.