Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Marykeller
on 20/12/2022, 09:57:27 UTC
NEW TOPIC
Username: Resident coin
Gender: male
Skill: student
State of origin: Akwaibom state

I dey very happy to see my fellow Nigerians here,I be newbie for here and I know sey many of you don master this forum. I just wan make we dey together as brothers and sisters, I hope say I dey welcome and we go make a good team??

Regards
Na Introduction post you do so, no label am new topic(lols) cos we no suppose to d talk about your name, gender, and location. Anyway, welcome to the forum. You do well as wan come show your face for here so that we go know who you be finally.

All of us wey d for this forum as Naija people d see ourselves as family. No discrimination in whatever the happen for here. We are all equal despite our backgrounds. Our vision for here na to help one another in spreading the knowledge of crypto to our friends wey d Naija and beyond. Make you feel free to ask any questions wey d bother you for crypto, you go get the answer here. Welcome once more and be blessed