Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Nigeria is known for scam by the people of the world,while we seeam as street.
by
CryptopreneurBrainboss
on 10/01/2023, 21:21:47 UTC
⭐ Merited by SatoPrincess (1)
Nigeria don dey among countries wey dem see say na dem Sabi scam pass for the world,and the way me I see the thing,e be like say we take glory inside the talk.So tey we don kukuma dey Callam "street."
Why e be say na dis one wey be like e bad nai people of the world go carry Sabi our name?

Make I shock you, if you dey talk of real scammers like men wey dey work with laptop defraud companies, organization wey be say dem be big shot, Nigeria no even follow for top 5 or ten self but na just say our lavish lifestyle dey kill our name because dem know say normally we poor for this side so anybody wey come dey live over large as our people sabi do na scammers. Also our African brothers dey portray demselves as Nigerian away most times so when dey catch dem dey gi say na Nigerians.

Nigerians are hard workers like the real ones. Oyah see us for here na, e get any other people wey hustle pass us I mean posting hustle oh no be all those bounty hunting (even there we still get representation). People self come dey jealous as e come belike we dey get am easily when den no realize say the level of hustle wey we dey put inside this forum much pass wetin others dey put in and we suppose dun get more recognition then dis

Sha just no reason am too much, no be say we dey celebrate fraud but Nigerian just dey find anything wey go make dem happy. We sabi find humor in every situation that's why e dey like we dey celebrate the fraud but Jo be so, give any Nigeria work na and see how him go over deliver instead wanting to join the street. That way self no easy as ritual dun enter the whole thing and wetin many people dey do now na ritual come use street cover up.