Peter Obi will win it

My broda nah here you cast your vote? No be to just use mouth talk am oh, carry your PVC take go the main polling unit go arrange yourself for who you go vote for oh, becos if nah here you wan do your vote e no go count oh.
🤣🤣🤣🤣
Na people like am go make Peter obi fail o, them no dey use mouth win election, na with pcv hope say as him the support Peter obi so em get em PVC, because na the only way em fit use make Peter obi win or any candidate, go collect pvc the deadline na January 22 ,make we make our votes count, becos we done too suffer for this country o, we no gats continue like this, them no dey win election on social media or bitcoin talk, them they win am for polling unit, so make we try make Nigeria better together.
Na true talk you yan like dis oh becos many of us like to talk for back but when time reach nah for house wey we go dy watch tv dy cheer person wey we want make em win. Election no be wetin we go just stand for road or any place say "I want this person to win" but when e matter well well our PVC nah to exchange am with ordinary #500 to vote the wrong person abi nah candidate them dy call am, ehen. The time nah now to choose the right person to carry us comot from this life style wey be like gutter put for better place make we smile for naija again.