Nigeria don dey among countries wey dem see say na dem Sabi scam pass for the world,and the way me I see the thing,e be like say we take glory inside the talk.So tey we don kukuma dey Callam "street."
Why e be say na dis one wey be like e bad nai people of the world go carry Sabi our name?
I tell you my brother the thing no they sweet me at all, for all these embassy guys to grant Nigeria visa now na problem because of waiting they done tag us and if na scam nigeria no scam reach all this oyinbo guys both their male and female esspecially for crypto, but any small thing now they go carry tittle give us. The truth be say our people to get for body if an that one,I know say he no easy but even at that no be excuse to scam.