and cum u self fit add ur own story on how u tak share ur time *SUSANO CARES *
Nothing you talk here but your topic title sweet me. Sometimes I dey wonder how married man wey dey here dey carry survived talk more of man wey get Children wey dey worry everywhere. Me I like peace of mind, when I dey enter forum so i dey like do am when everywhere quiet so i fit dey understand the post I dey read and the topic or reply wey I wan drop. Sometimes self I need read am loud to myself make I see if wetin I dun write make sense. This part na dey vex my banny as I go dey disturb am with words wey she never hear before.
I dun finally find wey to dey do am when she no dey around or she dey sleep, no be easy something oh something sha she go dey dey around but since I dun explain the whole hustle for her she dun come understand. Somedays self na she go remind me of forum. Woman normally need attention and when you no give am she go go outside go find am. So in everything you dey do, if you truely love your banny still dey find way show am love and commot your eye for phone make e no spoil your eyesight.