Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Food price in your area
by
CryptopreneurBrainboss
on 27/01/2023, 09:46:58 UTC
My area being ph, e rough well well and things like this na no go area especially to enter bus to the next bus-stop due to increase in fuel price.

I have think of to relocate from my area to another area in ph where food stuff will be cheap and affordable., if you know any area please drop it here, only for ph.

Make we yan

I noticed something for Port Harcourt, you see anywhere wey light dey 24/7 the food items in that areas na die meanwhile e no supposed be like dat. Normally e supposed be say if light dey den foodstuffs supposed no cost that area. I go iwofe then I come buy bole. Jesus 1.5k no fit give me better something self. Only the fish self dun chop like 5h and no be say na one kind big something like dat. Worst na if you come go dem transamadi dem or GRA area. All those residential areas wey big companies dey, e belike dem no dey do for doe normal people dat side. So if food they cost like this then wetin foodstuffs go dey costs.

You see this PH eh, dey your dey oh, no go dey think say one area better pass the other unless you wan give up some privilege wey you been dey get for your current area. Like you fit go where food no cost but road no come dey or light no come dey. Insecurities self wahala come follow. PH Normally things cost die, I just dey imagine how our Igbo brothers dey do for their own end as I understand say things for that side cheap die.