Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigerian election how una seya
by
ReignJimmy
on 06/02/2023, 19:10:23 UTC
Make i first thank una wey dey here before me and introduce myself as onyeeze, i come here come see say na my country na e dey here and i start dey read wetin una dey write and wetin una dey talk here and e make sense well well and na wetin make me i say make i follow una  put mouth here, i bi new person here and na yesterday wey i come here say make i follow una small, if una go fit direct me make una direct me. I will be ready to learn more

wetin i wan talk na matter of  politics of Nigerian, how una dey see this election wey come, the government of Nigerian dem dey into trouble now, wey bi say the cabal no get any decisions to tell Nigerians the person wey go become our oga presido now, wetin i see bi say zG5 Governor's don spoil cabal decision and any person wey G5 governor's support na them go win election, wetin bi your own talk for aspirates baba Tinubu if G5 governor's support him, and wetin bi your own opinion if G5 governor's support Atiku or Peter obi, who you think go win if the G5 governor's support and it will win election easily.

Sir, this year election is on God, this is how isrealites suffered before God gave them victory. God will surely give leader this year