Please i urge my fellow youths to refrain from letting any politician take advantage of us and we should turn out in large numbers on election days to cast our votes for the betterment of this country. As we all pray for free and fair election may we all witness it. Amen
Na mumu dey carry weapons go fight another man battle when him pikin dem full around but dey inside house dey protect demselves. Before you fight for anybody make you ask yourself where him own pikin dey and why him no dem come out to come carry the weapons demselves to fight for their pman or mumsy. I think our mumu dun too much and anybody that kills his fellow human being for this greedy men needs to be punished heavily. We supposed dun learn from our past mistakes and see say violence has never been an answer to anything.
Since wey we dey use the violence dey run the election, where him dun keep us so. Na so so mumu mumu leader dem wey we dey produced. This time around make we try something different and see if we fit get a positive result. Sha make I just believe say we dun wise up and we go consider our safety first before we begin to put our life on the line for this criminals dem that'll forget us immediately they enter that seat.