Wahala no they finish for this country oh, governor for kaduna tell him people say old and new naira note go still they in use say make them no fear till the Supreme Court decide other wise, talk say any person or any facility wei reject they old naira note go face they consequences.
Visitors go choke for kaduna state oh.
Na statements like this they make me say Buhari na mumu man a d his government na big setback for Nigeria, how a president go give order and a governor go wan go against the order. The worst part no be say the governor dey the opposing party and him wan just create misunderstanding but this one na him tight party person wey be Nasir Ahmad el-Rufai like instead of you to work with your president so una fit make everything dey okay. Maybe him dey find favor for him people hand so dem go elect APC again for Kaduna. Punishment suppose dey for this kind thing.
Make we forget say this policy come with big shock but we know say e no bad at all especially if we fit implement am well wey be say big cash no go dey dey outside the banks again. Any transaction go be electronically wey be say, person fit obsessed where the money dey from and where him dey go. E go bad for some political propaganda as dem fit use this spying dey monitor person but some kind crime like kidnapping for reduced unless kidnappers go wise up they use cryptocurency lol.