For this country if you lose your friends for one yeye politicians then I ahswear you be mumu!!!
Tinubu been support Atiku for presidential ambition for like twice, they are very Good friends na em correct guy. Peter obi been do Atiku Vice aspirant before na Good friends them be. You con they here they fight your correct guys, friends wei be say you suppose they build wealth with. Make we no lose guard oh for this country.
Bro you don try with this your advice and this na one of the best and finest piece I've seen since today and I wish I for award you But i no get.
I don see brother dey kill brother and pikin dey quarrel papa and mama just over persons wey dey share money behind close doors.
I dey always tell people say politics na game of personal interest and since politics na game ,na who Sabi play go win and Nigeria really need to visit their root to be able to win this war and what we need typically is a rugged good man that knows the game.