Na truth you talk but you dey forget say every skill wey person learn for this tech dey relevant in one way or the other. I go agree with you say some of the tech skills dey in higher demand than others but e nor mean say the other ones nor dey important too.
High in-demand tech skills dey very good to learn because dem go quick give you job and money go start dey enter your hand sharp sharp. Only say, this same high in-demand skills still get disadvantage because of the competition wey dey inside especially when you dey find job.
My advice na say make pipo learn any tech skill of their choice, especially the one wey dem go fit put all their mind. All tech skills dey relevant and lucrative, if you get passion for am, e go surely reward you at the end.